LinkWithin

header ads

Arsenal Manage Draw

Na real drama for Goodison Park as Arsenal manage draw 2-2 with Everton dem and dia two gols bin show inside de las seven minute sef.
Seamus Coleman bin score Everton fes gol for 19 minute and bifor haf time reach na so Steven Naismith come add anoda one to make am 2-kondo.
As all men dey tink say dem go waya Arsenal like dem do dem for Goodison las seasin, na so Arsenal sef come make swallow mouth.
Two gols for de las seven minute by Aaron Ramsey and Olivier Giroud come gif Arsenal de draw.
Minwhile Chelsea na dem be baba for EPL so afta de fes two matches as dem waya Leicester City wey just promote 2-0 for Stamford Bridge.
Two gols for secon haf from Diego Costa and Eden Hazard make am six points inside six for Jose Mourinho and hin boys come put dem for numba one for tabul.
Swansea bin beat Burnley 1-0 for Liberty Stadium as na kondo maket bitwin Aston Villa and Newcastle and also Southampton and West Brom.
Crystal Palace chop koboko from Crystal Palace for de London derby as Mauro Zarate, Stewart Downing and Carlton Cole score away for West Ham and na Marouane Chamakh score Palace onli gol.
Na Saturday EPL result be dis:
Everton 2 Arsenal 2
Chelsea 2 Leceister City 0
Crystal Palace 1 West Ham United 3
Swansea City 1 Burnley 0
Southampton 0 West Bromwich Albion 0
Aston Villa 0 Newcastle United 0

Post a Comment

0 Comments